Temptations in our nation: A poem in Pidgin English

Person go go school; Asuu and FG no go allow am graduate as at when due.

Person go subscribe or buy megabyte but no go get Megabite to take browse.

Shebi them say travel by air is very safe? Why for Naija we dey fear to travel by air?

Person go school finish; common job to take cool temper person no go see.

Police man wey dey safe guard civilians no go get better money as salary wey go do am to stop am to take bribe.

Person go put in positivity for him business but the atmosphere just dey knack am akpako with negativity.

Person go suffer build house finish na that time Government go remember say them wan plant flower there come demolish the house.

Person go steal Maggi them go burn am; but person wey tdey office dey steal billions just dey laugh dem.

Person  go follow pay tithes, contribution and offering for church so dem go fit build school but when dem build am finish poor man pikin no go fit attend.

Person go dress finish to go serve God; another one go come bomb am for inside God house chai!

Monkey they work; bamboo dey chop; these are but a few Temptations in the Nation. 

4 comments:

  1. Nice. But writing in pidgin eng isn't as simple as u think. The spellings matter and then again,consistency with the flow pidgin all throw the poem isn't there

    ReplyDelete

I hope you enjoyed this? Keep dropping your Comments as the Top 3 Overall Commentators will get gifts from Us at the end of the Month.